Pidgin Post – See Former Minister Wey Thiff Over N30 Billion As Dem Handcuff Am Like Who Thief Goat

See Mamman Saleh; a whole former minister of Power as dem parade am like person wey thiff for Oshodi!!!
See handcuff for him hand like person wey thief pregnant goat!!!

Dem sentence am to 75 years in prison because e thiff public funds wey pass N30 billion….
As dem sentence am, e come go hide for one house like this, na so EFCC go arrest am around 3am wey e still dey sleep…
Na money e thiff no be goat, dem suppose handcuff him left hand to him right leg.
If you be politician and you wan thiff, make sure say you get connection like former Kogi gov wey thiff billions but is free and on his way to the Nigerian Senate to represent him people.